Wia dis foto come from, Nigeria Presidency, Atiku Abubakar/Facebook Published one hour wey don pass Read am in 3 mins Presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC) Atiku Abubakar say Nigerians dey live wit di consequences of petroleum subsidy removal wey no get adequate protection for citizens during di transition. And for ova three years now, Nigerians dey live wit di burden wey don waka far, from petrol station to di bus-stop, to market and offices wia pipo dey work. Atiku Abubakar for di world press conference wey e do for Abuja tok say once petrol price go up, evritin dey follow am go up.
"Wen govment make energy expensive life go dey expensive." Im say dis tok no be argument again between economies but na wetin millions of pipo dey face for Nigeria. Di former vice president of Nigeria add say President Bola Tinubu dismiss im proposal to review di petroleum subsidy and bring beta intervention wey go bring down di cost of petrol. Atiku describe am as "ignorance wey president Bola Tinubu demonstrate on govnance and economy".
Atiku say govment suppose listen wen di Nigeria Labour Congress (NLC) call for support for workers sake of rising cost of petrol. Im explain say even business pipo, petroleum markets, market women and families dey feel di heat too and oga Tinubu no wan listen. As election dey come so di gbas-gbos between President Bola Tinubu and former Vice President Atiku Abubakar no be like wetin go end soon.
For di world press conference, Atiku tok about oda tins wey dey affect Nigerians. GDP Growth celebration Atiku Abubakar say across our factories, production cuts dey rise and goods wey dem neva sell dey pile up for warehouses. "Manufacturers dey struggle to continue to produce and families dey struggle to buy wetin di manufacturers dey produce.
"Di goods dey, di needs dey, wetin dey miss na di purchasing power," Atiku tok. Atiku add: "Govment dey celebrate Gross Domestic Product (GDP) growth, higher revenues and bigger allocations but Nigerians dey judge di economy wit wetin dia money fit buy. "If govment dey receive more naira while di naira wey di citizens get buy less food and less fuel and less electricity and less transportation, den bigger govment revenues no mean anytin to di families wey dey struggle to survive." Atiku tell President Tinubu say make e no make life unbearable for Nigerians and begin distribute bags of life.
We dey update dis tori
Source: BBC
Tech Breaking



